Shebi una remember that epic boxing match for Wembly stadium when Anthony Joshua smash down Wladimir Klitschko for round 11 in front of 90,000 fans wey stand up to clap? Immediately Anthony come be di most eligible bachelor for di world.
Di boxer still dey enjoy that victory. GQ don name am di Sportsman of the Year 2017. GQ call am: “National Treasure”.
Di part wey dey sweet us be say, Anthony Joshua get Nigerian blood. So as Britain carry am for head, na so we sef carry am for our own head. And you know say Nigerians sabi carry load. Na our property.
Congrats to di heavyweight champion!
❤
