Angelina Jolie: “This Single Life Nor Be Am At All” By Joy Isi Bewaji


.
Na so.

Angelina Jolie confess say single life hard for am.

Plenty things dey worry Jolie. Apart from the divorce wey she file for September, 2016, she also get some health issues wey dey do am.

Remember say she do double mastectomy for 2015, abi? Apart from that she also remove her ovaries, she get hypertension, and she dey deal with one sickness dem dey call - Bell’s palsy.

With all this issues, she nor wan' stay this life alone. Thankfully, di two of dem, she and Brad Pitt, don pause di divorce proceeding. Dem dey try work out their marriage.

Make we shout hallelujah for di matter.

Jolie and Brad Pitt get six children – Maddox, Pax, Zahara, Shiloh, Vivienne and Knox. So yes, e go good if dem fit work am out.

Marriage nor easy. Make she come Nigeria see as women dey hang on top di thing like ceiling fan.
Previous Post Next Post