TIMAYA CONFESSION: BEFORE BEFORE, I BE SEX TOY! BY JOY ISI BEWAJI



Timaya yarn PUNCH say, before before im run comot for house go live with one woman for Portharcourt wey dey use am as sex toy anytime wey she need, you know, servicing of her body.

Timaya also talk for di interview say, im come from family wey dey “fairly comfortable”, dat one mean say dem hold small pepper and dem nor need to beg.

Ok. So why Timaya run comot for house? “I be rebel”. Na so im talk.

Timaya rebel sotay e enter woman house, dey service her body so dat di woman go give am food and house to stay.

Dis matter na wa. And im dey talk di thing like say im be victim. Your papa and mama nor poor wey be say dem nor fit feed you, but you rebel your way go meet woman wey want sex… years later now, we dey read di thing for paper as one of your “travails”, as one of your sufferhead hustle wey happen to you.

But na “travail” true true?

Imagine if na woman talk dis kain thing, we for don break her head, carry Jezebel dash am as new surname.

Just imagine if na Tiwa Savage, Linda Ejiofor, Seyi Shay or Toke Makinwa talk dis kain thing… social media for don tie wrapper, carry cane dey mad upandan.

But as e be say na man talk am, na “travail”. If na woman? E for be “ashawo” “prostitute” “vagabond” “useless thing” “husband snatcher” yada yugu!

“She use me as sex toy”, how na, Timaya?

No be say we wan knock im hustle oh, but dis tori suppose get part two, and dat part two must contain your age and other mende-mende.

Still, we happy for you. You don win on top your music career. So for dat one, tuale!
Previous Post Next Post