HOW OLD BE ENIOLA BADMUS? BY JOY ISI BEWAJI



E never tay when Eniola Badmus knack another year join for her age. She don do party sef, jollificate with her fellow actors. 

But world people nor go let her rest. Dem don dey talk di matter for twitter and blogs: wetin be Eniola Badmus real age?

Hian! Di tin tire us. The actress talk say she be 34, world people say na lie, she be 40!

Nor be person wey get age go know im age? Abi una dey use size of body take look person age? E nor dey work like dat. Big bone nor mean say di person don old.
Some world people don carry Funke Akindele enter di matter. Dem dey compare Funke and Eniola. Dem say if Funke na 40, then Eniola suppose be di same age. Dat yarn make sense?
Everybody get dia own body. You no suppose use one person body take judge another person.
Abeg make we leave matter. Una president sef no sure how old im be.

See her fine fine birthday pictures.













Previous Post Next Post